top of page

Who no want IVF baby?

Woman wey dey find pikin, na im know di kain pain wen she dey experience

Some dey get husband wey go beat dem, odas go experience breakdown of their marriage -all on top say dem never born pikin.


IVF (In-Vitro-Fertilisation) na opportunity wey plenti women around di world, wey no fit get belle easily dey get from their doctor – and e dey work wella!

So wen we come dey hear say some pipo dey feel say IVF baby, no be ‘real’ baby or di mama no be real woman, e dey make us vex seriously!


Wetin be IVF?

IVF na medical procedure wen sabi doctor dem go take egg from woman, take sperm from man, come join dem togeda for hospital .

Di sperm go fertilise di egg .

After dat, dem go inject dis egg wey di sperm don fertilise inside woman uterus where baby dey normally grow


Wetin you suppose know about IVF?


  • No be today IVF start IVF don dey available for almost 50 years and sabi pipo wey dey monitor IVF, tok say since dem born di first IVF baby in 1978, over 12 million babies don drop, sake of IVF

  • IVF no be only woman problem. Sometimes, nothing do di woman, but na di man fit get problem. For example him fit no dey release enough sperm or di sperm no dey gree waka sharpally reach di egg

  • Some pipo dey tok say IVF baby no be di mama and papa bodi e comot NA LIE! Na di sperm or di papa and di egg of di mama dem go join togeda, wey go form di baby

  • Some pipo dey also tok say baby wen dem born wit IVF  go dey sick all di time NA LIE! Baby wey dem born wit IVF go dey healthy like baby wen den no born wit IVF

 

Which famous pipo don do IVF?

IVF na veri common procedure wey dey bring di joy of new pikin to many pipo around di world. Some famous pipo for Naija and oda places don even tell us say dem do IVF wen dem dey find pikin .

 

For example:

  • Adesua Etomi-Wellington

  • Ufuoma Mcdermott

  • Michelle Obama- former first lady in America (Barack Obama wife)

  • Mariah Carey

  • Celine Dion

  • Kim Kardashian

So, if you dey find pikin and you get option to do IVF, abeg no allow anybodi mumu kill your hope o.

Go for it!NOW!

 

©wetindoyou April 2024

 

bottom of page