top of page

Na who we be?”

Wetindoyou na di wok of sabi pipo like doctor and pharmacist wey get mind to help evribodi dey take beta care of dem sef.


We wan encourage make pipo share tori  and ask kweshon about health problem wey dem get. 
Plenti pipo get problem wey dem no dey tok about - if we no tok about our problem, e go hard to get help to deal wit am. We wan make all man fit to yarn dia tori

​​

Get Beta Advice
Yarn Your Tori
Come Join Us

Na wetin we dey try do?


Pipo dey tok say knowledge na pawa. Na di same wit our health.
Na im be say if you sabi wetin do you, you go begin understand how you fit solve di problem.​

Our plan na to give evribodi chance to learn more about different health problem wey fit affect us. We wan try do dis in a way wey plenti pipo go sabi.


Das why we gada health information and advice in pidgin English, di language wen plenti pipo fit understand

Meet our pipo

Wetindoyou na di work of ogbonge pharmacist and doctor wey determine to improve pipo knowledge about their health

bottom of page