top of page

Diabetes

Information and advice in Pidgin English

Wetin e be?

 

Diabetes dey happun wen shuga wey dey inside pesin blood dey too high.
All man get shuga for blood and na one kain chemical wey dem call insulin dey control di shuga level for our blood.
Normally after we chop and di food break down into shuga and oda tings, come enter blood, na insulin dey break down di shuga and allow am enter body well well to give us enerji.
Pesin wey get diabetes no dey fit break down di shuga because im bodi no fit produce insulin or sometimes di insulin wey bodi produce no work well.

Diabetes never get cure and most pipo go dey treat am for all dem life.

If pesin manage di disease well, e dey easy to live long life like pipo wey no get di disease

​

Type 2 Diabetes

Na two type of diabetes na im dey: Type 1 diabetes and Type 2 diabetes.

 

Type 1 diabetes

 

All man get immune system wey dey prevent bodi from disease. Wen pesin get Type 1 diabetes, na di bodi own immune system go attack and destroy di cells (part of di bodi) wey dey produce insulin. If bodi no produce insulin, shuga level for blood go rise, come damage bodi organ and bodi fit shut down. Type 1 diabetes dey usually start before pesin reach 40 years, especially as pesin become teenager. Wen small pikin get diabetes, e go usually be Type 1 Di treatment for Type 1 diabetes na insulin injection togeda wit regular exercise, healthy balanced diet and checking blood shuga regularly

Type 1 diabetes no dey too common like Type 2 diabetes but e fit develop veri quickly (like a few hours or days)

​

Type 2 diabetes

 

Wen pesin get Type 2 diabetes, e mean say dem no fit produce enough insulin or di insulin wen dem produce no work wella for bodi.

Pesin wey get Type 2 diabetes fit control di disease if im dey chop beta healthy food, dey do regular exercise and dey check im blood shuga regularly. But on top all dis, most pipo go need to take medicine join.

Different tablet and injection dey available to treat Type 2 diabetes but dem no go work if pesin no dey watch wetin im dey chop and do regular exercise.

Type 2 diabetes dey common wit pipo wey get too much bodi fat.

Plenti pipo fit get Type 2 diabetes for many years make dem no know because di signs wey go show no dey always make am clear say na di problem di dat.

 

Which sign dey usually show if pesin get diabetes?

 

  • Pesin go dey feel testI (go wan drink water)

  • Pesin go dey piss more dan normal (especially for night)

  • Pesin go dey feel veri tired

  • Pesin go dey loose weight

  • Pesin go dey itch around penis or vagina

  • If you get wound or cut, e go tey behore e heal

  • Pesin vision go dey blur (pesin eye no go clear to see well)

  • ​

If you notice any of dis problem, e dey really important to ask your doctor make im check you.

Also, na good idea to tok to your doctor if somebodi for your family (like your mama, papa, broda sista, grandmama or grandpapa) get diabetes or if you get heavy weight, so im go fit advise you about how to prevent diabetes.

bottom of page