top of page

Depression

Wetin be Depression?

Depression na wen pesin dey get feeling of sadness wey dey last for long time, like weeks or months and dis feeling no gree go.

E dey normal for evri bodi to feel unhappy sometimes but dis feeling dey usually go away within days. If di feeling dey drag pesin for longer time, na im be say dem fit get depression be dat.



Some pipo dey feel say depression no be real sickness, say no be big tin or say na sign of weakness.

No be so at all o

Depression na serious health mata.

Weda you be man or woman, depression na real tin and e fit affect anybodi

But if pesin wit depression get correct treatment and support, dem fit recover fully


How to know weda pesin dey get depression

Depression dey affect pipo in different ways, and dem fit show different signs. For example:

  • Pesin fit dey feel unhappy and hopeless and dem no go fit shift dat feeling

  • Dem fit lose interest in di tins wey dem dey normally enjoy to do

  • Dem fit just wan cry about any small tin

  • Many pipo wey get depression go dey get feeling of fear

  • Most of di time dem go dey tired and no go dey sleep well

  • Dem no go get appetite to chop

  • Dem no go get appetite for sex

  • Dem fit get ache and pain for bodi

Some pipo fit get mild depression, wey be say dem dey feel unhappy most of di time, while odas fit get very serious (severe) depression wey be say dem go start to feel like dia life no worth anything and make dem kukuma end am


Wetin dey cause depression?

No any one particular tin dey cause depression.

Different pipo dey get different reason why dem dey feel depressed

For some pipo, na one tin wey happen for dia life and for odas e go be combination of different tins

  • Stressful tin wey happen: E dey hard for many pipo to cope with difficult situation wey dey happen as part of life e.g. wen pesin wey dey close to dem die or maybe pesin get relationship problem. E dey more easier for pipo wey experience dis kain issue to get depression especially if dem no dey mix with dia friend and family anymore and dey try solve di problem on dia own

  • Family history: Although e no dey always happen, but sometimes if pesin get parent, broda or sista wey don get depression before, e dey more likely say dem too go get depression (especially for pipo wey get severe depression).  

  • After giving birth: Many woman dey get wetin dem call postnatal depression wey be say different changes for dia bodi and di worry say dem go dey responsible for new baby fit cause depression

  • Menopause: Some women dey get depression especially in di first few years after dem reach menopause (wen dia period stop to dey show)

  • Loneliness: Pipo wey dey lonely, no get family and friends to mix wit, dey more likely to get depression

  • Alcohol and drugs: Many pipo dey try use alcohol and hard drugs like weed to take away dia sorrow . Dis wan no dey advisable as e dey more likely to push dem enta depression

  • Illness: If pesin get long term sickness or sickness wey dey cause serious pain like cancer, e dey more likely for dem to get depression

Wetin to do if you suspect depression?

E dey veri important for pesin to get help from doctor if dem suspect depression. Make dem no delay


Many pipo wit depression go get good benefit if dem improve dia lifestyle- like to dey do more exercise, reduce di amount of alcohol wey dem dey drink, stop smoking and to dey chop beta healthy food


E dey important for pesin wit depression to get opportunity to dey yarn wit anoda pesin , so on top medicine wey doctor fit recommend, dem fit send pesin to get professional tok-tok treatment where dem go try use tok-tok to help depressed pesin feel beta about dia self.

 




Kommentarer


bottom of page