top of page

Feminine Hygiene



How woman suppose dey care for her genital area


Only use warm water clean her genital area

Many women no dey realise say the natural water wey vagina dey produce dey prevent make bacteria dey grow for dat area. Wen you use different kain soap or vaginal wash dem, dis one go fit encourage bacteria and oda yamayama dey grow for di area


No dey use perfume, deodorant, soap, douche or feminine wash Even di one wey dem tok say e dey specially for di feminine area go usually contain chemical wey fit irritate di skin. Instead make you wash with warm water (no be hot water o!)


Make you no dey over wash! OR over dry!

Once evri day done do – if you over wash, you fit wash all di beta bacteria comot, leave di bad ones. And make you use clean towel dry di area softly softly, no dey use too much pawa


No dey comot your pubic hair

E get reason wey you get pubic hair – na to protect dat area from doti and bacteria. No dey wax or shave your pubic hair, e beta to just trim am

 

Try maintain healthy weight, especially for your  inner thigh area

Most of di time, di main odor wen woman fit dey smell for dat area, nor be from di genital at all – usually e go be from the inner thigh and skin wey fold or rub togeda for dia. You fit start exercise wey go help reduce fat for dis area


No dey wear tong , pant or under wear wey tight

No dey wear underwear sleep for night – you suppose free your sef. During di day, di best option na white cotton underwear wey no tight


Wash your panties with mild soap

Separate dem from other cloth wen you dey wash


Make you dey use pad or tampons during your period.Make e no dey tay before you change your pad or tampon, so e no go dey leak. If na reusable pad you dey use, make you dey change am regularly – wash am before you use am again


©Wetindoyou May 2025

Comentarios


bottom of page