Fibroid
- fouadkl
- Jul 5, 2022
- 3 min read
Updated: Jan 28
Plenti women go don hear about fibroid before. Infact, e dey so common, all man go get mama, sista, wife or relative wey get am or go don hear about somebodi wey don get fibroid.
So wetin be fibroid?
Fibroid na some kain tin wey fit grow inside woman uterus (womb). Uterus na where woman egg dey stay after sperm from man don fertilise am , come dey develop into new baby. Many women fit no know say dem get fibroid because e no dey always give any sign say e dey there. Fibroid dey get different size- some dey veri small (small pass groundnut) and others dey grow veri big, reach di size of watermelon

Some of di common sign wey fit show wen pesin get fibroid na:
Period dey heavy or painful
Serious pain for belle
Pain for lower back
Pain for woman wen she dey have sex
Constipation (when e dey hard to poopoo
Pesin go wan piss all di time
If woman get fibroid wen she dey pregnant, e fit affect development of di baby or cause complication wen di woman ready to born
Also, if woman dey try get belle and she get big fibroid, e fit no allow di belle to stay
Na who fit get fibroid?
Fibroid dey veri veri common among women. Around one woman out of evri three woman go get am during their life and usually e dey happen when woman dey between thirty to fifty years old.
Fibroids common pass for Black African women dem and e dey happen more wit women wey dey veri fat.
Women wey don born dey get lesser chance to get fibroid.
How to confirm say you get fibroid
If you dey experience some or all of di sign wey we talk about before, make you go see doctor.
DI doctor go fit check and confirm whether you get fibroid. E fit ask you to do :
Ultrasound scan : to see wetin dey inside your womb
Hysteroscopy: dem go pass small camera through di vagina to reach inside di womb, so dem go fit see wetin dey inside.
Laparoscopy: dem go pass camera through small hole wey dem go make for di lower part of your belle (abdomen). E go allow di doctor to see all di organ wey dey inside your abdomen. So, if di fibroid dey inside your womb or for anoda area, dem go fit see am.
Doctor go need to make you sleep when dem dey do dis work
Wetin be di treatment for fibroid?
A lot of di time, e no dey necessary to get treatment for fibroid, especially if e no give pesin any problem (plenti women no dey even know say dem get fibroid, as e no dey worry dem)
Fibroids dey usually shrink as woman reach di age of menopause (di age when woman period dey stop)
But if you get fibroid wey dey disturb you, plenti option dey for doctor to treat you.
Dem fit give you medicine wey dey reduce heavy period. If di fibroid big well well, dis kain medicine fit no work well
If dat one no work, e get medicine wey fit shrink di fibroid. Na gynaecologist (special doctor for woman matter) dey sabi about dis kain medicine, so you fit ask your normal doctor to send you go see gynaecologist
If medicine no work and di fibroid still dey give serious problem, then na surgery remain. Na different kain surgery dey:
Hysterectomy: dis one na surgery to remove di womb and na women wey no plan to born again suppose get dis kain surgery. Sometimes, hysterectomy dey cause make woman reach menopause quicker and e fit reduce woman sex drive (when pesin no go too feel like sex)
Myomectomy: Dis na surgery to remove di fibroids from inside di womb and e dey better for woman wey still wan get children. E dey important to know say sometimes di fibroid fit come back and e go dey necessary to do di myomectomy again.
E dey very important to discuss wit your doctor which kain treatment go better pass for you.
Comments