top of page

Migraine

Updated: Mar 7, 2024

Wetin be Migraine?

Migraine na serious headache wey dey usually cause heavy, sharp pain for one side of di head. Togeda wit di sharp headache, many pipo go also feel like say dem eye dey turn, like dem go vomit and dem no go fit cope for where light or small noise dey

Migraine na veri common problem.

But e dey affect women pass men.



Na different kain migraine dey:

  • Migraine with aura- Dis kain migraine dey give warning before e show. E go be like say pesin dey see flashing light.

  • Migraine without aura-Na dis kain migraine dey very common. E no dey give warning at all. E go just come.

  • Silent Migraine- Pesin go dey feel di oda signs of migraine but di headache no go gree come.

 

Sign wey dey show for Migraine

Di number one sign of migraine na serious headache for one side of di head.

Sometimes, di pain fit affect di two side of di head and e fit affect di face or neck. As pesin dey waka di pain dey increase and e fit stop pesin from carrying out e normal activity.


Some oda signs wey fit show include:

  • Sweating

  • Pesin no go fit concentrate

  • Bodi go dey hot di pesin

  • Slight tummy pain

  • Belle go dey run di pesin

  • Eye go dey turn di pesin

Wetin dey Cause Migraine?

Dem neva sure  of  di exact tin wey dey cause am but na mostly because of abnormal activity for brain wey dey affect di nerve and blood vessels wey dey inside.

Many pipo wey dey get migraine, go get some of dia family members dey get am too


Tins Wey Fit Start Migraine

  • Change in bodi hormone: Some women dey experience migraine around di time wey dia period dey start. Dis na because di amount of hormone wey dey dia bodi dey change.

  • Stress

  • Anxiety

  • Tension

  • Shock

  • Depression

Oda tins wey fit cause migraine na:

  • Tiredness

  • If Pesin no sleep well

  • Bad Posture

  • Shoulder tension

  • Low blood sugar

  • Exercise

In some pipo, diet fit trigger migraine too:

  • If pesin no chop

  • If pesin no drink water

  • If e take alcohol

  • If e drink tea or coffee

  • Some food like chocolate or cheese

Some tins for di environment around us fit cause migraine like:

  • Veri bright light

  • Blinking screen

  • Smoking

  • Loud noise

  • Strong smell

  • Change in weather

Some drugs fit cause am too;

  • Sleeping tablets

  • Contraceptive pill

  • Hormone replacement treatment (HRT)

If you start medicine new and you dey get migraine, follow your Doctor talk


Dem no dey fit predict migraine, sometimes e go come with only headache, sometimes oda signs fit follow am. No single test dey to know if na actually migraine pesin get. Most times Doctor dey do physical examination wey e go use check if na migraine dey worri di pesin.

E dey always dey helpful for doctor if di pesin dey keep record of di migraine as e dey come. Di pesin need to note:

  • Di date wey di migraine happen

  • Di time

  • Wetin pesin dey do wen e happen

  • How long e last

  • Which signs di pesin see

  • Which food di pesin chop

  • Which medicine di pesin take

How Dem Dey Treat Migraine?

Migraine no get cure.

But treatment dey wey fit help reduce am.

Wen migraine dey worry pesin, make pesin try stay inside room wey dark, e fit help reduce am.

Pesin fit also try pain relief medicine till e see di one wey work for am.

But if pesin take too much pain relief medicine e dey make di migraine hard to treat. Pesin no suppose take pain relief medicine pass 10 days every month.


If pain relief medicine no work, pesin suppose see doctor. E go prescribe di right medicine for you or e fit refer you go specialist for proper treatment



Recent Posts

See All

コメント


bottom of page