top of page

Antibiotics and Mekwe! - video

Updated: Mar 14, 2024

‘Abeg give me Amoxil, I just nack raw’

‘Doctor, I wan buy antibiotic make I use am wash sperm comot for my belle’

You don go ask dis tin for Pharmacy or Chemist before?

Mani pipo dey do am, especially after dem get sex without protection. Sometimes one of dia friends dey advice dem or dem feel say e dey normal to use antibiotics after unprotected sex. Dem believe say if dem take am, Sexually Transmitted Infections (STIs) like Syphilis, Gonorrhea, HIV and oda ones wey dey around, no go worry dem. Some pipo still talk say, dem fit use am prevent belle. For dia mind di antibiotics go wash dia bodi clean come remove every yama-yama wey fit dey inside. Abi you sef tink so?


Wetin be Antibiotic? Antibiotic na type of medicine wey dey fight infection wey bacteria dey cause for bodi. Na different kain antibiotic dey -some go work well for one kain infection and odas go work well for anoda kain infection. E fit be tablet, cream, capsule or even liquid. So, to remind you, di work of antibiotic na to fight infection wey bacteria dey cause for bodi. Finish! E no dey do any oda tin pass dis one o! Na only wen doctor confam say you get infection na im you suppose use antibiotic


Belle no be bacteria infection! For you wey dey take antibiotic ‘wash belle’, make you stop now, your mumu don do! Antibiotic no dey prevent belle. If you wan prevent belle, na contraceptive you go use – beta to ask your doctor or pharmacist advice before you do di nacking


Wetin you need to know about Antibiotic and STI

No be all STI bacteria dey cause. Infection like HIV, Herpes and Hepatitis - na virus dey cause am. Antibiotic no fit do anything to dem – na anoda kain medicine go treat dem So if you dey carry take antibiotic anyhow, you just dey waste your time and you come still dey spoil your bodi join. If you wan prevent STI:

· Make you dey always use Condom - no dey nack raw!

(Unless you get only one partner and understand say di woman fit get belle if she no use oda prevention)

· Dey go do test regularly (if you get more dan one partner) STI fit dey inside bodi and e no go show for face.


Antimicrobial Resistance If pesin use antibiotic too much e no go dey work again to fight or kill bacteria. Dis na wetin dem dey call Antimicrobial Resistance. If pesin overuse antibiotic and e stop to dey work, pesin fit come later get sickness wey na only dat antibiotic fit treat - sometimes no oda medicine fit work for dat sickness. How e go come do am? Das why doctor dem no dey carry give antibiotic anyhow Dem go first check di sign wey your bodi dey show, den ask make you do medical test before dem go know di kain medicine wey dem go give you.

So Last Last, Wetin we don Talk ?

· Di work of antibiotic na to fight infection wey bacteria dey cause for inside bodi

· Na only wen doctor confam say you get infection na im you suppose use antibiotic

· If pesin use antibiotic too much e no go work again to fight or kill bacteria.

· If you wan prevent belle, na contraceptive you go use, no be antibiotic

Always follow your doctor or pharmacist tok anytime wey confusion dey about wetin you go do if you nack without protection.

Comments


Commenting on this post isn't available anymore. Contact the site owner for more info.
bottom of page